INTRO
This one na for some women
wey dey go find pikin for native doctor
hear am
Mummy, I want to drink small stout [you say]
Daddy, I want to drink small stout [See wahala]
Uncle, I want to drink small stout
Hey shut up, this pikin we no go give you small stout
CHORUS
Pikin [Ehn]
you dey hungry [yes]
wetin you want to chop [I want to drink small stout]
This pikin [Ehn]
you dey hungry [yes]
I say wetin you want to chop [I want to drink small stout]
This pikin [Ehn]
you no go suck breast [no]
wetin you want to chop [I want to drink small stout]
Shut up pikin, we no give you small stout
[Noooooooo]
Cry, cry, nonsense
VERSE 1
One fateful morning as all of us dey sleep for yard
One man dey rake him wife
my friend I need a child
This na regular quarrel, so everybody came out
we said stop, pause, oga, madam, dont shout
The woman vex
come hear her friend advice
make she go meet baba
of course she met baba
then baba gave her a charm to help her get a child
1 2 3 4, the woman belle come out
she said I’m blessed, come go give testimony for church
everybody wey dey for church give am round of applause
but she forget say satan gift dey like time bomb
when e blow, the little boy go metamorphose
waiter
give my son a bottle of fanta
No na daddy, I want to drink small stout
Shut up my friend, which kain pikin you be self
Ehh God, I go kill this pikin today
REPEAT CHORUS
Uncle, I want small stout [You can’t be serious]
Big one nko [Shut up there]
what of gulder [You dey craze?]
OK Tombo [see wahala]
Kai kai [I no go give you]
ehn ehn, una no wan give me
then I go smoke Igbo [smoke now]
then I go smoke Igbo
VERSE 2
Abeg parents, watch your children
and the friends they keep
Cos small small girls of nowadays
na them get front of jeep
some are tall, looking old
but na 10 years dem be
if her friends take alcohol
she will want to take a sip
Now she’s getting out of hand
please mummy use your whip
Teach your daughters the fear of God
tell her to close her zip
HIV no dey show for face oh
what you sow, you reap
this is just an advice,
you have a choice to either run or leave
REPEAT CHORUS
only God can solve all your problems
only God can heal your sickness
only God can take away your pains
only God can clear all your shame
I’ve tried native doctors (x3)
but no one can stop them (x2)
