News Shared is News Heard !

 

Nigerian national identity card: How to use your phone get your National ID card from NIMC mobile app

Nigerian national identity card

Wetin we call dis foto, National ID card

Nigerians go fit begin dey use dia phone to get dia National ID cards without long queue, according to di National Identity Management Commission (NIMC).

NIMC bin launch mobile app wia pipo fit access dia original National Identification wit dia foto, den print am for paper or plastic.

Dis development dey come many years afta plenti Nigerians bin complain tire say dem neva get dia National ID card afta dem register long time ago.

If you wan get your Nigerian National ID card from your phone, dis na how you go do am.

Download di NIMC mobile app

Nigerian national identity card

Wetin we call dis foto, NIMC mobile app screenshot

Di first tin wey you need to do na to download di NIMC mobile app from di Google Playstore if na Android phone you dey use or App Store if na iPhone you dey use.

Put your NIN number and phone number

Afta you don install di app, di next tin na to type your National Identity Number (NIN) wey dey your national identity slip or you fit dial *324# for your phone to get di number.

Den you go type your phone number wey you use register your national ID card.

Nigerian national identity card

Wetin we call dis foto, NIMC mobile app screenshot

Read di Attestation and enta your pin

Di next tin na to read di attestation den click ‘I Agree’ to continue. Den you go enta di pin number wey you like – make sure say you no forget am – click ‘Finish’ to go di last stage.

Last stage

For di final stage, you go see all di menu wey dey di NIMC Mobile ID app. Wetin you need to do na to click on ‘Show my ID’ and your national ID card don ready for you to download and print out ontop paper or plastic. Shikena!

No forget say na only those wey don apply for national ID card fit get di National Identity Number wey dem go use download di ID card.

If you no get your NIN, you go first need to go do your National ID card Enrollment wey dey free of charge, according to di NIMC Head of Corporate Communications, Kayode Adegoke.